MAKE UNA LAUGH: BUSHMEAT DON CATCH D HUNTER
a housewife in realising dat the housemaid is behaving funny decided to engage her.
MADAM: chinyere why u don begin dey behave anyhow these days, e bi like say u no wan know ur mate for this house o!
face no dey fear face for ur village? abi u don carry craze for head?
CHINYERE: look at u you call urself madam, which kind wife u be? afterall my food dey sweet pass ya own...
MADAM: Ehn!!!! who told u dat u cook beta than i do?
CHINYERE: na oga now.....
MADAM: lord have mercy!!!!!!!! papa nkechi!?

!!!!! you will come and meet for this house today..... na war btw me n him today. ehenn i don dey suspect this thing since......
CHINYERE: no be all be that o......... i even pass you for bed
MADAM: yepah!!!!!!!!!!!!!!! im finished, so papa nkechi told u such thing too?
CHINYERE: mba, na driver talk dat one o
MADAM: Uhmm!! chichi baby, chiyerryrrry, chilonsky, chi chi of africa... come here my darling, good girl. Abeg no let oga hear dat one o, devil no go pour sand for ur garri o, ok?