News:

Ramadan Mubarak!

I pray that we get the full blessings of Ramadan and may Allah (SWT) grant us more blessings in the year to come.
Amin Summa Amin.

Ramadan Kareem,

Main Menu

LATEST, HOTTEST GOSSIP ABOUT K-MEMBERS!!

Started by ummita, March 05, 2003, 02:14:17 PM

Previous topic - Next topic

0 Members and 6 Guests are viewing this topic.

Dan-Borno

sank u beri moch po yo peshens ol of una, specially my coper
prend mudacris ze man who cross river yobe with frog jump and
the only mouse and curso op kanoonline.  kema hafsy_lady, i
always mistake you po my darling sweet chocolatee butter the
other hafsee - anybody with her whereabout will receive a mighty
reward gaskiya - i am in deeply in luv.

i dont know why these girls keep on doing iyonga po young men
like me with future ambition of may be becoming the next speaker
of the national assembly - kai haba, now if den swear me as the
speaker i go start to dey receive txt message say i know this chap
in kanoonline ko? women ke nan una too dey like were una go get
enough butter for una bread, may god help una.

make i no divert from my tory wey i dey panel beat for the past
few weeks, ka san u have to make sure sey the tory dey aunthentic
and real even if the pesin involve institute legal action against you
you go fit prove am sey the thing happen real. no be sey na so so
rumour rumour dey fly over.

you no say gradually the world is turning everythin in E, e-learning,
e-business, e-book, e-newspaper, e-revolution including e-religion
dey - kai, even last year e-marriage don happen koro koro for my
eye, the couples are yet to meet and mate because e-mating is soon
releasing then e-pickin will also follow after, but this e-pickin no go
reach 9 months o, na that time wey una met the e-pickin go comot
and if there is a serve failure the pickin fit comot for afghanitan and
join the famous incorruptible taliban - na wah for technology.

kanoonline dey bring all sort of people, he doesnt differentiate btw
the good and the bad even the ugly and the beauty sef in go join together.
on 16th of that month wey i dey talk about, before the gtg for kano,
kai i really enjoy that gtg, muda, where those beautiful girls dey, abeg
make we meet and talk, somebody wey dey harass people anyhow in
this forum dey eye am and e no fit tell you - i go gist you later, let this
tory no disrupt the one i wan nack una.

some serious forum go ask you to even put up ur address, so that they
will be sure say no be virus be their member, amma for kanoonline even
virus go come register and give himself funny name wey no dey our
dictionary, you go crack your brain but can not fitgure the meaning of the
member's username. una remember that funny tufokia or wetin be the
name sef.

let me answer this call:

DB:      hello, y u dey hide ur number ne? u be witch?
Caller:  o boy, this tory wey u wan publish for forum, i carry my grandpapa
            wey die trying to learn english from mungo park make you no release
            am.
DB:      oya, but the girl tell me say make i release the whole tory patapata so
            that everyone go hear wetin u do
Caller:   a, ominin pariyo - i don die
DB:       hallo, hallo, hallo
GSM:    Network connection error
"My mama always used to tell me: 'If you can't find somethin' to live for, you best find somethin' to die for" - Tupak

Nuruddeen

Quote from: Dan-Borno on February 27, 2009, 09:44:30 AM

Gyare!!! Make una continu d tory wey de itch yu finish. Lol!!!
o try and fail is atleast to learn. That will save one the inestimable loss of what might have been (positive or negative).

HUSNAA

Kai DB! ashe you have such a great sense of humor haka? I couldnt stop laughing at yr post!! ebaby in afghanistan....hahhaaa that takes the cake!! it really does ;D ;D ;D ;D keep it up!! ;D ;D ;D ;D ;D
Ghafurallahi lana wa lakum

ummita

Quote from: Dan-Borno on February 27, 2009, 09:44:30 AM
i am in deeply in luv.
Daddy badai kishiya kake kokarin yin ma mumsy ba? Wallahi ayi hankali ko yarinya ta zama REBEL. >:( >:( >:( >:( >:( >:(

This is one hilarious read...............
Despite ur slammin, am still jammin!!!

Muhsin

Nagode Allah. Ai da na tsorata, thinking the released gossip was about...guees the rest.  ;D
Get to know [and remember] Allah in prosperity & He will know  [and remember] you in adversity.

ummita

Bad boy kawai. Me kayi kana tsorata a fada? >:( >:( Kai! This must be serious. I will summon your aunty very soon to make opaque what you are hiding in your closet.
Despite ur slammin, am still jammin!!!

Muhsin

Nothing, Ummita. Paranoia, they called it? Thats all. LOL

You know dad din naki. He's toooooo dangerous when it comes to gossiping. He's what I can describe as an omnicient gossiper. Remember my alledged meeting with bazawara and encounter at CIT, BUK, to mentioned but two, he reported. LOL ;D  ;D
Get to know [and remember] Allah in prosperity & He will know  [and remember] you in adversity.

Lawwali

DB, a beg meki compilit de tory mana, or de caller don bribe you with de gir.......................
talk am now :( :( ;D ;D
it takes oppressed and oppressor for oppression to occur

Lawwali

Now, eperi bodi can read de writin on de wall, only one pesin for dis forum can call aunty's son to order. Dama dem tel me say na paper tiger him be for dem presence. LOL ;) ;) ;)
it takes oppressed and oppressor for oppression to occur

Dan-Borno

Quote from: ummita on February 27, 2009, 11:25:25 PM
Daddy badai kishiya kake kokarin yin ma mumsy ba? Wallahi ayi hankali ko yarinya ta zama REBEL. >:( >:( >:( >:( >:( >:(
this one is suppose to be between me & u, dont allow the
waduzs, muhsins, lawwalis dem be yan adawa, they wan
see me and my daughter fall apart which is not going to
happen lailai forever, god forbid bad thing, olori buruku
thunder go fall on top of our enemies.

wetin dey worry una for this forum? who ask me to give
tory in the first place? if i vex, i no go complete the tory
sef - haba - gulma wuya kawai.

de bobo na lecturer po one of this federal universities, but
en sabi do this night chatting well well and e never know
say the girl na en student.  she no mind if the tory is published
because the bobo-lecturer do the girl harm no be small.
god forbid bad thing, this lecturers, before dan maraya used
to say teacher uban karatu, now e don change to teacher
uban yan iska.  he confessed in this forum in 2007 that he is
in lust with one of his student, the guy na wowo wo, imagine
singing her name while delivering lecture, wai batutula batula
waye ya dame ki batutula, ina kinjeni batutula. all the students
were agape and dont know what to say before he comes to
his senses.  amma fa the girl good, good for body (back & front)
eben the tinted glasses na factory made, no bodily damage,
during the last session convocation, the vice chancellor deliberately
made her an usher so that eben the traditional ruler from the east
who is the pro chancellor go throwey saliva - kai kam ba dama
wallah, god sabi creation no be small, every knee must bow at
the sighting of his creation.

muhsin!!!!!!!!!!!! in ba karambani ba wetin carry u go dey befriend
woman wey experience pas you, now, your lifan don break down
and the semester is heating up.  next time, let me give you the
the recommended specifications.

I wish......... phone ringing

DB:      Hallo
Caller:  Zis is the president of the federal republic of nigeria and CinC of the armed forces
DB:      your excellency
H.E       sank you beri much for your concern, i read your article in daily trust
DB:      wrong number your excellency, i never write article in newspaper
H.E:      i thought ur ze one who wrote about ze 7 point agenda of my administration
DBL      no your excellency, but if you want i can also write in collaboration with my friends
H.E       no sank you, but are you sure zis is a wrong number?
DB:      yes your excellency, wrong number
H.E       now that you have the opportunity to talk with me, do you have anything in mind
            to tell me concerning my administration?
DB:      sank you your excellency for giving me this opportunity.  my froblem is;
            i am a fresh graduate with no work, i dont mind working inside aso rock.
H.E       i see, we have just sent a bill to the national assembly which will enable us
            provide 1,000,000 million jobs to the teaming youth in nigeria, and insha Allah
            i will ask my minister of labour to include you among the 1,000,000
DB:      your excellency
DB:      your excellency
i tried rediling the number again
....the number you are calling is not available at the moment, pls try again later....

"My mama always used to tell me: 'If you can't find somethin' to live for, you best find somethin' to die for" - Tupak

*~MuDa~*

Kai Danborno, i can see you have exumed the other buried side of yourself to the open air, you are one hell of a guy....lol, i laughed that my lip cut open by the side....harmattan...lol!
...He begot not, nor is He begotten!
www.articlesdir.co.cc

Hafsy_Lady

Hehehehehhe. Su Dan-Borno kenan. But ni nafi son irin gulmar da za'a fadi sunayen mutane kiri kiri tafi dadi ai musamman ma na yan nan forum din.

@ Muda, chabdijan  :o wannan wacce irin harmattan ne haka? Kodai yunwa ce! :-\ Anyway sha, amke you acquire and apply Vaseline petroleum Jelly
What you see is what you get[/b]

Dan-Borno

Hafsy lady kenan, so want me make i call name boro boro,
oya, tun da kin zuga ni bani na soma daga kanki.

hey guys, kun san cewa Hafsy lady is one hell of a lady, hmm,
two months ago she happens to be somewhere (not to be
disclosed) kwasam sai kawai ga.....

wait o, i just remembered a very fresh gulma.  anybody that
is broke should just contact our board moderator, kwannan a
ka bashi wani irin very very fat loan a uba - he is planning to
marry a lady who was a former member in this forum, all my
efforts to get her name proved abortive, however, i have
hired TKTK to check very well and report back.
"My mama always used to tell me: 'If you can't find somethin' to live for, you best find somethin' to die for" - Tupak

bakangizo

See how you dey chnage from amebo to comedian ;D YOu be chameleon? I recommend you for the AY Show!

Dan-Borno

"My mama always used to tell me: 'If you can't find somethin' to live for, you best find somethin' to die for" - Tupak